How I Overcame Loan Apps Debt and Rebuilding My Life

Make I share my story with loan apps with everybody. It started in January 2024 when I dey urgently need money to pay my shop rent. I beg many people for help, but nobody gree help me.
Make I share my story with loan apps with everybody. It started in January 2024 when I dey urgently need money to pay my shop rent. I beg many people for help, but nobody gree help me. One friend advise me make I borrow online, she introduce me to Easemoni, where I borrow 68k to repay 90k for two months. I need more money, so I just waka go Play Store download more apps, most of dem na 7 days duration. Na so my wahala start.
I go borrow from one to pay the other, and within a month, I dey owe about 15 loan apps. The number just dey increase till I realize say I owe about 28 of dem. I dey gradually lose my sanity, no peace, dem dey call and message me nonstop. I dey fear say dem go spoil my name because of wetin my contacts go think. My blood pressure dey go up and down, I dey cry every day until I get liver tell my favorite uncle wey dey abroad.
Na him rescue me, he make sure say I repay all of dem. The money we repay na about 1.8 million naira if I no dey mistake. E pain me well well, but for my peace, we do am and I stay away from all loan apps until April when one agent start dey message me say I dey owe BGloan 50k. I no pay attention until she send my picture dey talk say I be ritualist, she even send am to some of my contacts.
I vex well well, I just decide to borrow from all the apps I don repay to take revenge. Since then, I don remove my SIM, open new WhatsApp, dey enjoy my life. To hell with my contacts, dem no fit do anything when I need dem pass. I just tell my family members say anybody wey call dem na scammer.
It's been three months now, and I'm enjoying my iPhone 12 wey I buy with the money. Nobody fit fear pass me again, but since I join this group, I no fear anything.
Join our Facebook Group

Related Testimonies




Safe Loans


.webp)





(1) Comments
Those loan apps will add overdue charges only to defame you This contact is for one flexicash agent +234 703 530 1465
Write a comment