How I Overcame Loan Apps Debt and Rebuilding My Life

How I Overcame Loan Apps Debt and Rebuilding My Life
Details

Make I share my story with loan apps with everybody. It started in January 2024 when I dey urgently need money to pay my shop rent. I beg many people for help, but nobody gree help me.

Make I share my story with loan apps with everybody. It started in January 2024 when I dey urgently need money to pay my shop rent. I beg many people for help, but nobody gree help me. One friend advise me make I borrow online, she introduce me to Easemoni, where I borrow 68k to repay 90k for two months. I need more money, so I just waka go Play Store download more apps, most of dem na 7 days duration. Na so my wahala start.

I go borrow from one to pay the other, and within a month, I dey owe about 15 loan apps. The number just dey increase till I realize say I owe about 28 of dem. I dey gradually lose my sanity, no peace, dem dey call and message me nonstop. I dey fear say dem go spoil my name because of wetin my contacts go think. My blood pressure dey go up and down, I dey cry every day until I get liver tell my favorite uncle wey dey abroad.

Na him rescue me, he make sure say I repay all of dem. The money we repay na about 1.8 million naira if I no dey mistake. E pain me well well, but for my peace, we do am and I stay away from all loan apps until April when one agent start dey message me say I dey owe BGloan 50k. I no pay attention until she send my picture dey talk say I be ritualist, she even send am to some of my contacts.

I vex well well, I just decide to borrow from all the apps I don repay to take revenge. Since then, I don remove my SIM, open new WhatsApp, dey enjoy my life. To hell with my contacts, dem no fit do anything when I need dem pass. I just tell my family members say anybody wey call dem na scammer.

It's been three months now, and I'm enjoying my iPhone 12 wey I buy with the money. Nobody fit fear pass me again, but since I join this group, I no fear anything.


Join our Facebook Group


Comments (1
  • User loan Review

    Those loan apps will add overdue charges only to defame you This contact is for one flexicash agent +234 703 530 1465

    • 8/20/2024
Write a comment
Related Testimonies
How I broke free from the claws 35 loan apps
How I broke free from the claws 35 loan apps - Loan Shark Review
7,522
   
0
Practical steps to be free from Loan Shark Apps
Practical steps to be free from Loan Shark Apps - Loan Shark Review
4,019
   
0
This website and Say no to Sokoloan Facebook group are God sent to me
This website and Say no to Sokoloan Facebook group are God sent to me - Loan Shark Review
3,310
   
0
Stages to pass through before you'll finally know the truth about Loan Sharks
Stages to pass through before you'll finally know the truth about Loan Sharks - Loan Shark Review
3,098
   
0
FAQ
Loan Apps and Bankruptcy: What You Need to Know (Lendsafe)
Loan Apps and Bankruptcy: What You Need to Know (Lendsafe)

Loan Apps and Bankruptcy: What You Need to Know

View Details
Are the following Loan apps Registered (Kashflex )
Are the following Loan apps Registered (Kashflex )

Are the following Loan apps Registered

View Details
Loan Apps: A Blessing or a Curse? (9Credit)
Loan Apps: A Blessing or a Curse? (9Credit)

Loan Apps: A Blessing or a Curse?

View Details
Ethical Concerns Surrounding Loan Apps (Cash9ja)
Ethical Concerns Surrounding Loan Apps (Cash9ja)

Ethical Concerns Surrounding Loan Apps

View Details
Loan Apps: Borrow with Caution (Cash9ja)
Loan Apps: Borrow with Caution (Cash9ja)

Loan Apps: Borrow with Caution

View Details
Loan Apps and Social Responsibility (LairaPlus)
Loan Apps and Social Responsibility (LairaPlus)

Loan Apps and Social Responsibility

View Details
Loan Apps: What Happens if You Can't Repay? (Lendsafe)
Loan Apps: What Happens if You Can't Repay? (Lendsafe)

Loan Apps: What Happens if You Can't Repay?

View Details
Loan Apps and Bankruptcy: What You Need to Know (AidaCredit, Alend, 9Credit loan-Instant loan Cash, Ease Cash)
Loan Apps and Bankruptcy: What You Need to Know (AidaCredit, Alend, 9Credit loan-Instant loan Cash,  Ease Cash)

Loan Apps and Bankruptcy: What You Need to Know

View Details